1 Samuel 13
13:1 Saul na thirty years wen e start to rule; e rule for more dan forty years.
13:2 Saul selet 3,000 men from Israel for ensef. 2,000 from di men, dey with Saul for Mikmash and for Bethel kountry for di hill; while di remainin 1,000 dey with Jonatan for Gibeah for Benjamin. E kon send di rest pipol go house.
13:3 Leta, Jonatan kill Filistia sojas for Gibeah and all Filistia pipol kon hear about am. Den Saul blow trumpet take koll all di Hibru pipol make dem kom fight.
13:4 Israel pipol hear sey Saul don kill Filistia sojas wey gada for Gibeah and Filistia pipol kon hate dem. So all Israel pipol kon go join Saul for Gilgal.
13:5 Filistia pipol gada to fight Israel pipol; dem get 3,000 shariot, 6,000 men for horse and dia sojas plenty like san-san wey dey wotaside. Dem kon go kamp for Mikmash wey dey di east side for Bet-Aven.
13:6 Dem attack Israel pipol well-well and Israel sojas kon run go hide for di kaves, holes, inside rocks, pits and wells;
13:7 some run cross Jordan River kon enter Gad and Gilead aria. Saul still dey Gilgal and di pipol wey dey with am, don dey fear.
13:8 E wait Samuel for der for seven day, just as Samuel don tell am, but Samuel neva still kom Gilgal. So di sojas kon dey run leave Saul.
13:9 So Saul sey, “Make una karry di burn ofrin and di peace ofrin kom.” Den e kon do burnt ofrin.
13:10 Wen e don do di ofrin finish, Samuel kon kom. Saul kon go outside go greet am.
13:11 But Samuel sey, “Wetin yu don do so?” Saul ansa, “Wen I si sey di sojas don dey run leave mi and yu neva kom for di time wey yu suppose kom and I hear sey Filistia pipol don gada for Mikmash,
13:12 I kon sey, ‘Filistia pipol go kom meet mi for Gilgal and I neva ask God make E favor us.’ So I kon do di ofrin.”
13:13 Den Samuel tell Saul, “Na foolish tin yu don do so o-o! Yu nor obey di kommandment wey di Oga yor God give yu. If to sey yu obey, God for make yu king for Israel forever.
13:14 But naw, yor kingdom go end. Bikos yu nor obey am; God go fine di kind pesin wey E wont kon make am king wey go rule en pipol.”
13:15 Den Samuel go Gilgal and from der to Gibeah for Benjamin. Saul shek di sojas wey still dey with am and dem bi like six hundred.
13:16 So Saul, en pikin Jonatan and di sojas wey dey with am kon kamp for Gibeah for Benjamin, while Filistia pipol kamp for Mikmash.
13:17 Filistia sojas divide dia kamp into three group. One group face di road wey dem dey pass go Ofrah for Shual land;
13:18 anoda group face di road wey go Bet-Horon and di last group kon dey waka go di road wey go di borda where dem for dey si Zeboim Valley for di desert side.
13:19 E nor get anybody wey fit do iron work for Israel, bikos Filistia pipol nor wont make Israel pipol dey make swods and spears.
13:20 So wen Israel pipol wont sharpen or do any knife, den must go do am for Filistia pipol land.
13:21 Di money wey dem dey pay na one koin to sharpen axe and ripair shepad stik, den two koin to sharpen big and small hoes.
13:22 So wen di war start, na only Saul and en pikin get swod and spear, no oda soja for Israel karry swod or spear.
13:23 Filistia pipol kon send some sojas make dem go block Mikmash road.