Library · pcm

Genesis 12

12:1 Naw, God kon tell Abram sey, “Komot from yor kountry; leave yor relashon and yor papa house kon go di land wey I go show yu. 12:2 “Den I go turn yu to one strong kountry kon bless yu. Yor name go dey great and yu go get betta blessing. 12:3 I go bless doz wey bless yu, but doz wey curse yu, I go curse dem too. All di family for dis eart, go get blessing, bikos of yor name.” 12:4 So Abram kon go, just as God tell am sey make e do and Lot follow am go too. (Naw, Abram na seventy-five years wen e komot from Haran.) 12:5 Abram take en wife Sarai, en broda pikin Lot and evritin wey e get, plus di pipol wey dey with dem for Haran and all of dem kon go Kanaan land. 12:6 Abram travel pass Moreh oak tree for Shekem. (For dat time, Kanaan pipol dey stay for di land.) 12:7 God appear to Abram kon sey, “I go give dis land to yor shidren-shidren.” So Abram build one altar to God wey appear to am for der. 12:8 Den e komot from der go di hill kountry for Bethel for east kon stay der. E build anoda altar for der for God kon woship am. 12:9 Abram kon dey travel small-small until e rish Negev. 12:10 But honga kon dey di land, so Abram go Egypt go stay der small, bikos di honga strong well-well. 12:11 As e near Egypt, e kon tell en wife Sarai sey, “Si o-o, I know sey yu bi fine woman 12:12 and wen Egypt men go si yu, dem go sey, ‘Dis na en wife.’ Den dem go kill mi bikos of yu. 12:13 So make yu tell dem sey, yu bi my sista, so dat dem nor go kill mi.” 12:14 Wen Abram enter Egypt, Egypt pipol si as di woman fine well-well. 12:15 Wen Fero offisa si di woman, dem kon tell Fero about am 12:16 and e trit Abram well, bikos of di woman. Abram kon kollect sheep and kattle, both man donkey and kamel. 12:17 But God kon send one bad diziz enter Fero house, bikos of Sarai, Abram wife. 12:18 So Fero koll Abram kon sey, “Wetin bi dis wey yu don do so? Why yu nor tell mi sey dis woman na yor wife? 12:19 Wetin make yu sey, ‘Di woman na my sista?’ Naw, I don take am as my wife! Make yu take di woman and make una komot for here!” 12:20 So Fero kon orda en offisa make dem porshu Abram, en wife and evritin wey bi dia own, komot from di town.