Library · pcm

Genesis 13

13:1 So Abram komot from Egypt kon go Negev. E take en wife, Lot and evritin wey e get follow body. 13:2 (Naw, Abram get many animals, silva and gold.) 13:3 E dey travel from one place go anoda, from Negev go rish Bethel. Den e kom back to di place wey dey between Bethel and Ai, where e for first put en tent. 13:4 Dis na di place where e for first build altar. So Abram kon woship God for der. 13:5 Lot wey dey travel with Abram, still get animals and propaty too. 13:6 So di land nor big rish for di two of dem, bikos dem dey togeda and dia animals too many. 13:7 So Abram men and Lot men wey dey look afta dia animals kon bigin kworel. (For dat time, na Kanaan and Periz pipol dey stay for di land.) 13:8 Abram kon tell Lot, “Make mi and yu nor kworel and make awa men nor kworel too, bikos wi bi brodas. 13:9 So make wi separate. Choose any part for di land wey yu wont. Make yu go one side, while I go-go di oda side.” 13:10 Lot look well-well from Jordan River aria go rish Zoar. E kon know sey evriwhere for der get betta green plant and dem get betta wota like Oga God gardin for Egypt. (Dis na before God distroy Sodom and Gomorrah.) 13:11 So Lot choose di whole River Valley for ensef kon waka go di east side. Dis na how Abram and Lot take separate. 13:12 Abram stay for Kanaan and Lot kon stay for di town wey dey di valley and e kamp near Sodom 13:13 wey en pipol wiked and dey sin against God. 13:14 Afta Lot don go, God kon tell Abram sey, “Make yu look from di place where yu stand to di nort, sout, east and west. 13:15 All di land wey yu dey si so, I go gi-am to yu and yor shidren-shidren forever. 13:16 And I go make yor shidren-shidren plenty like san-san for di eart and nobody go fit kount dem. 13:17 So make yu get up go look di land dem, bikos I go gi-am to yu.” 13:18 So Abram karry en tent kon go stay near Mamre oak wey dey Hebron and e build anoda altar for God for der.