Library · pcm

2 Chronicles 11

11:1 Wen Rehoboam rish Jerusalem, e koll 180,000 strong sojas from Judah and Benjamin tribe sey make dem go fight Israel tribe wey dey di nort side. 11:2 But God tell Profet Shemaya sey, 11:3 “Make yu go tell Rehoboam, Judah and Benjamin pipol sey: 11:4 ‘Make una nor attack una own brodas wey bi Israel pipol, but make all of una dey go una house, bikos evritin dey happen, just as I wont am.’ ” So all of dem obey God kon go dia house. 11:5 King Rehoboam for Jerusalem guide and build wall round dis towns for Judah: 11:6 Betlehem, Etam, Tekoa, 11:7 Bet-Zur, Soko, Adullam, 11:8 Gat, Maresha, Zif, 11:9 Adoraim, Lakish, Azeka, 11:10 Zorah, Aijalon and Hebron. Na dis towns dem guide well-well for Judah and Benjamin. 11:11 E guide dis towns well-well kon put ofisas der with store wey dem put food, olive oil and wine. 11:12 Shield and spear dey for evry town. E make dis town strong well-well. Na-im get Judah and Benjamin. 11:13 Di priest and Levi pipol wey dey Israel, still dey support am no matter where dem dey stay. 11:14 Levi pipol leave all dia propaty and betta land kon kom Judah and Jerusalem, bikos Jeroboam with en shidren nor gri make dem serve as God priest. 11:15 King Jeroboam appoint en own priest dem to dey serve for di woship place and for di juju altar wey e make. 11:16 All di pipol for Israel wey won woship Israel God follow dem go Jerusalem go sakrifice give dia grand-grand papa God. 11:17 Dem support Judah kon obey Solomon pikin, King Rehoboam for three years. Dem follow David and Solomon laws for three years. 11:18 King Rehoboam marry Mahalat wey David pikin, Jerimot born and en mama na Abihail wey Jesse pikin, Eliab born. 11:19 Dem born three sons: Jeush, Shemaraya and Zaham. 11:20 King Rehoboam still marry Maaka, wey bi Absalom pikin and dem born four sons: Abijah, Attai, Ziza and Shelomit. 11:21 All Rehoboam wife na eighteen and en girl-friends na sixty. E born twenty-eight sons and sixty dotas. Na Absalom pikin, Maaka e like pass among en wifes and girl-friends 11:22 and na Maaka pikin Abijah, e like pass among di oda shidren. So e kon choose Abijah as king afta am. 11:23 E use sense put en sons as leaders for Judah and Benjamin aria and oda towns wey dem dey guide well-well. E dey give dem evritin kon marry many wifes for dem.