Library · pcm

2 Chronicles 12

12:1 Wen Rehoboam dey rule and don get pawa well-well, en and Israel pipol kon rijet God law. 12:2 Bikos dem nor dey follow God law again, for di fift year wey Rehoboam dey rule, King Shishak for Egypt kon attack Jerusalem. 12:3 King Shishak bring 1,200 shariot, 60,000 horse-men and many sojas follow am kom from Egypt, Libya, Sukk and Kush. 12:4 E seize Judah town wey dem fence well-well kon mash face Jerusalem. 12:5 Profet Shemaya visit Rehoboam and Judah leaders wey gada for Jerusalem, bikos of Shishak kon tell dem sey, “Dis na wetin God tok: ‘Una don rijet mi, so I go rijet and give una to Shishak.’ ” 12:6 Israel leaders and di king honbol demsef kon sey, “Na di korrect tin God dey do so o-o.” 12:7 Wen God si sey dem don turn kom meet am, E kon tell Profet Shemaya sey, “Dem don honbol demsef, so I nor go distroy dem again. I go soon diliver dem. I nor go use Shishak take show Jerusalem pipol as I dey vex rish. 12:8 But Shishak go win dem, so dat dem go know di difren between to serve mi or oda rulers.” 12:9 King Shishak for Egypt attack Jerusalem kon karry all di good tins wey dey di temple and di gold shield wey Solomon make. 12:10 King Rehoboam make gold shield take replace dem kon put ofisas to guide di palis gate. 12:11 Anytime di king go di temple, di guards go karry di shields kom out, den take dem go back to di guard-room wen di king don komot from di temple. 12:12 Afta Rehoboam honbol ensef, God nor vex distroy am again and evritin kon dey progress for Judah. 12:13 King Rehoboam kingdom kon strong well-well for Jerusalem. E bi forty-one years wen e start to rule and e rule for seventeen years from Jerusalem, di town wey God choose among all Israel tribe as en house. King Rehoboam mama kom from Ammon and en name na Naamah. 12:14 E sin against God bikos e nor gri serve am with en whole heart. 12:15 Evry oda tin wey King Rehoboam do, dem rite am put for Profet Shemaya and Profet Iddo history book. 12:16 Den Rehoboam die and dem beri am for David Town. En pikin Abijah kon take-ova as king.