2 Chronicles 16
16:1 For thirty-six years wen Asa dey rule for Judah, King Baasha for Israel kon attack Judah. E put sojas for Rama, so dat nobody go enter or komot from di town.
16:2 King Asa take all di silva and gold wey dey di temple and di royal palis kon send dem with message go give King Ben-Hadad for Siria, wey dey rule Damaskus sey:
16:3 “I won enter agriment with yu as awa papa do. I don send silva and gold kon give yu. So make yu break yor agriment with King Baasha for Israel, so dat e go komot from my land.”
16:4 King Ben-Hadad gri with wetin King Asa tok, so e send en sojas go attack Israel towns. Dem win Ijon, Dan, Abel-Maim and all di towns where Naftali pipol dey keep tins put.
16:5 Wen King Baasha hear di news, e karry en sojas kon komot from Rama.
16:6 King Asa orda Judah men sey make dem karry di stones and wood wey Baasha take block Rama komot. E kon use dem take build Gibeah and Mizpa.
16:7 For dat time, Profet Hanani visit King Asa for Judah kon tell am: “Bikos yu bilive Siria king pass God, yu nor go fit win Siria sojas again.
16:8 Kush and Libya pipol nor get plenty sojas, shariot and many men wey dey ride horse for dem? But wen yu trust God, E kon give dem to yu.
16:9 E klear sey na God dey wosh di whole world and E dey ready to give pawa to doz wey trust am. Yu nor use sense for dis matter, so from naw go, na so-so war yu go dey fight.”
16:10 Asa vex well-well for di profet, so e kon put am for prison. Dat time, King Asa still vex opress some pipol.
16:11 All di tins wey happen wen King Asa dey rule, dem rite dem put for Judah and Israel kings history book.
16:12 For thirty-nine years wen King Asa dey rule, e kon get diziz for leg. Even doh di sickness dey worse well-well, Asa nor gri pray to God at-all, instead e kon dey go meet difren doctors.
16:13 King Asa die for di forty-first year wey e bi king.
16:14 Dem beri am for en own grave for David Town. Dem pour spices and betta oil for en body kon make and burn big fire to take honor am.