2 Chronicles 17
17:1 Asa pikin, Jehoshafat kon take-ova as king.
17:2 E pak sojas full Judah towns kon send some go difren place for Judah land and for Efraim towns wey en papa seize.
17:3 God bin dey with Jehoshafat wen e start to rule, bikos e dey obey God like David en grand-grand papa. E nor gri serve juju,
17:4 instead e serve and obey en grand-grand papa God. E nor do like Israel pipol.
17:5 Bikos God guide en kingdom, Israel pipol kon take gift go give Jehoshafat, so e get enough money and pipol kon dey respet am.
17:6 E like to obey God and e skata evriwhere wey dem for dey woship Asherah juju for Judah.
17:7 For di third year wen e dey rule, e send Ben-Hail, Obadaya, Zekaraya, Netanel and Mikaya wey bi en ofisas go tish pipol for Judah towns.
17:8 Shemaya, Netanaya, Zebadaya, Asahel, Shemiramot, Jonatan, Adonijah, Tobijah and Tob-Adonijah wey kom from Levi tribe and Priest Elishama with Priest Jehoram, still follow dem.
17:9 Dem dey tish Judah pipol from di book wey God law dey. Dem travel go all di towns for Judah dey tish di pipol.
17:10 God put fear for all di kingdom wey near Judah and dem nor fight with King Jehoshafat at-all.
17:11 Some Filistia pipol bring many silva and gold as gifts kon give Jehoshafat. Arab pipol bring 7,700 rams and 7,700 goats from dia animals kon gi-am.
17:12 Jehoshafat kon dey get pawa more-more. E build big-big house and towns full Judah.
17:13 E get many tins wey e store for Judah town kon keep many sojas for Jerusalem.
17:14 Na like dis dem take divide dia families: dem get 1,000 ofisas from Judah. Adnah wey bi kommander, dey lead 300,000 strong sojas.
17:15 Jehohanan wey bi kommander, dey lead 280,000
17:16 and Amasaya wey bi Zikri pikin wey sey e go serve God, dey lead 200,000 strong sojas wey get skill.
17:17 From Benjamin family: Eliada wey bi strong soja dey lead 200,000 men wey karry bow and shield,
17:18 while Jehozabad dey lead 180,000 strong sojas.
17:19 Na dis ones serve di king, apart from doz wey di king put for di strong towns for Judah.