Library · pcm

2 Chronicles 2

2:1 Solomon sey make dem build one temple to take honor God and one royal palis for ensef. 2:2 Solomon get 70,000 ordinary workers and 80,000 men wey dey kut stone for di mountin, plus 3,600 men wey dey supavise di workers. 2:3 Solomon send message go meet King Hiram for Tyre sey, “Make yu kom help mi, just as yu help my papa David, wen yu gi-am cedar wood make e take build en palis. 2:4 I dey ready to build one temple to honor di Oga my God and to dedikate am gi-am. I go burn betta incense for am; offa bread and burnt sakrifice evry morning and evening and for Sabat Day too. I go do di same tin for new moon festival and evry oda tin wey di Oga my God tok. Dis na wetin Israel pipol go dey do. 2:5 I go build betta big temple, bikos awa God big and betta pass evry oda gods. 2:6 True-true! Who fit really build temple for am, since di sky and di heavens wey high pass too small for am? Who I bi to build temple for am? E go just bi where dem go for dey offa sakrifice gi-am. 2:7 So, make yu send somebody kom; pesin wey know how to work with gold, silva, bronze and iron, plus purpol, crimson and violet klot. Pesin wey fit design well-well. E go work with my men wey sabi karve tins for Jerusalem and Judah, bikos na David my papa train dem. 2:8 Make yu send cedar wood, evagreen and algum trees for Lebanon kon give mi, bikos I know sey yor savants sabi kut trees. My savants go work with yor savants, 2:9 so dat dem go fit give mi many wood make I take build betta big temple. 2:10 Si, yor savants wey go kut di wood, I go pay dem with 20,000 bag of wheat, 20,000 bag of barley, 120,000 gallon of wine and 120,000 gallon of olive oil.” 2:11 King Hiram for Tyre kon send dis leta go give Solomon: “Bikos God love en pipol, E kon make yu king.” 2:12 Hiram still sey, “Na di Oga God for Israel deserve all di praiz, bikos na-im make di sky and di eart! E don give David one pikin wey wise and undastand sey e suppose build temple for God, plus royal palis for ensef. 2:13 Naw, I dey send Hiram kom meet yu. E sabi di work well-well; 2:14 en mama kom from Dan tribe, while en papa na from Tyre. E know how to work with gold, silva, bronze, iron, stones and wood; plus purpol, violet, white and crimson klot. E still know how to make difren design. E go work with yor men and yor papa David men. 2:15 Naw, make my oga send di wheat, barley, olive oil and wine as e promise kom give en savant; 2:16 wi go get all di wood wey yu wont from Lebanon kon arrange dem kom give yu thru Joppa Sea. So yu fit karry dem from der go Jerusalem.” 2:17 Solomon kon still kount all di men wey bi strenjas for Israel, afta en papa David kount evribody for Israel. All of dem na 153,600. 2:18 E make 70,000 of dem ordinary worker; 80,000 dey kut stones for di mountin, while 3,600 dey supavise di workers, to make sure sey di pipol komplete di work.