2 Chronicles 3
3:1 Solomon kon start to build God Temple for Jerusalem on-top Mount Moraya, di place where God for appear to en papa David, but na Araunah wey kom from Jebus, get der before.
3:2 Solomon don dey rule for four years wen e start to build for di sekond day for di sekond mont.
3:3 Di foundashon wey Solomon build for God Temple long rish 90 fit (akordin to as dem dey measure before) and wide rish 30 fit.
3:4 Di varanda for di main hall front na 30 fit, while di temple wide and high rish 30 fit. Solomon design inside di temple with pure gold.
3:5 E make di main hall with board wey dem make from evagreen trees; design am with fine gold kon dekorate am with palm trees and shains.
3:6 E dekorate di temple with precious stones and na from Parvaim dem from bring di gold wey e use.
3:7 E still design di house, di beams, di wall, di post and all di doors wey dey di temple and e karve tins wey bi like angel for di walls.
3:8 E make di Most Holy Place long rish 30 fit, while di temple wide and deep rish 30 fit too. E design am with fine gold wey dear rish 600 silva koin.
3:9 Di nail for di gold heavy rish 50 shekel and e still design di up with gold.
3:10 For di Most Holy Place, e make two image wey bi like angel kon design dem with gold.
3:11 If dem put di angels feada togeda, e rish 30 fit. One for di first angel feada long rish seven and half fit and e tosh one wall for di temple; why di oda feada na still seven and half fit and e dey tosh di sekond angel feada.
3:12 One for di sekond angel feada still long rish seven and half fit and e dey tosh di oda wall for di temple; di oda feada na still seven and half fit and e dey tosh di first angel feada.
3:13 If yu add di two angel feada togeda, na 30 fit dem bi. Dem stand well face inside di temple.
3:14 Na violet, purpol, crimson and white klot, Solomon take make di curtain kon design and dekorate am with tins wey bi like angels.
3:15 For di temple front, e make two pila and dem long rish fifty-two and half fit and each of dem high rish seven and half fit.
3:16 E make strong shains kon put dem on-top di pila. E still make one hundred fruits wey get many seeds kon dekorate and join dem to di shains.
3:17 E put di pila for di temple front; one for di rite side and di oda for di left, den e koll di one for rite, “Jakin” and di left one, “Boaz.”