Library · pcm

2 Chronicles 4

4:1 Solomon make one bronze altar wey long rish 30 fit; wide rish 30 fit and e high rish 15 fit. 4:2 E still make one bronze basin kon koll am “Di Sea.” If dem measure am from one side to di oda, na 15 fit e bi; e round for shape kon high rish seven and half fit. Di basin round rish 45 fit. 4:3 Bull wey dem karve dey under am for evriwhere. One melu image dey under am for evry step. Di bull dey two side and dem join dem to “Di Sea.” 4:4 “Di Sea” stand on-top twelf bull. Three face nort, three face west, three face sout and three face east. “Di Sea” dey on-top dem and all of dem face outside. 4:5 E tick rish three inches and di tins wey dem take hold am, dey shine like lily flower. E fit kontain like 18,000 gallons of wota. 4:6 E make ten basin wey dem fit take wosh: E put five for di sout and five for di nort side. Na inside di basin dem for dey wosh di tins wey dem dey take do di burnt sakrifice; but di priest dey wosh inside “Di Sea.” 4:7 E make ten gold lampstand just as e suppose bi kon put dem for di temple; five for di rite side and five for di left. 4:8 E make ten tabol kon put dem for di temple; five for di rite side and five for di left. E still use gold take make one hundred bowl. 4:9 E make di kourtyard for di priests, di big kourt and di door for di kourt kon design dem with bronze. 4:10 E put “Di Sea” for di sout-side for di sout-east korna. 4:11 Hiram make di pots, shovels and bowls. E finish all di work for God Temple, just as King Solomon tell am. 4:12 E make di two pila, di two bowl wey dey on-top di two pila, with two shains wey dem design for di top 4:13 di 400 fruits wey get many seeds wey dem take design shains for di pilas (each of di design get two of dis fruits on-top di pila), 4:14 di ten stand wey dem fit move with di ten basins, 4:15 di big bronze basin wey dem dey koll, “Di Sea” with di twelf bull wey dey under; 4:16 di pots, shovels and di meat fork. All di tins wey King Solomon give Hiram make e do for God Temple, dem make dem with bronze wey dem polish. 4:17 Di king sey make dem mold dem kom from Jordan River, between Sukkot and Zaretan. 4:18 Even with all dis many tins wey Solomon make, di bronze dem still remain. 4:19 Solomon still make all dis fine tins for God Temple, di golden altar and di tabol wey e go put di sakrifice bread; 4:20 plus di gold lampstand with dia lamps wey go dey burn for di Most Holy Place, just as Moses kommand 4:21 and na fine gold dem take make di flower, di lamp and di tongs. 4:22 Na pure gold dem take make di wick iron, di bowl, spoon and di censer. Na gold dem still take make di door-mot, di house front, inside di door and di temple door.