Library · pcm

Job 10

10:1 “Life don taya mi; so make Yu hear as I dey tok how my heart betta rish. 10:2 I go tell God sey, ‘Before Yu kondemn mi, first tell mi wetin I do wey make Yu dey vex.’ 10:3 E good as Yu dey opress mi? Yu dey opress wetin Yu make with yor hand. Yu dey happy for wetin wiked pipol dey do? 10:4 “Yu dey si tins di wey wi dey si dem? Abi Yu get di kind eye wey human being get? 10:5 Yor life short like awa own? Abi yor years know long life awa own. 10:6 Den wetin make Yu dey look for my sins and evry mistake wey I make? 10:7 Even doh Yu know sey I nor dey guilty, e nor get who fit save mi from yor hand. 10:8 “Na di same hand wey Yu take make mi, Yu won take skata mi? 10:9 Make Yu remember sey na san Yu take make mi; so Yu won turn mi to dat san again? 10:10 Na yor pawa my papa take born mi; na Yu make mi grow for my mama belle. 10:11 Yu make my body with bone kon kover am with flesh and skin. 10:12 Yu don give mi life kon show mi yor love wey nor dey die. Na bikos yu kare for mi naim make mi still dey alive. 10:13 But na naw I know sey for all dat time, Yu dey plan to wound and kill mi. 10:14 Yu dey look to si weda I go sin, so dat Yu nor go forgive mi. 10:15 If I sin, na big wahala Yu dey give mi, but if I do betta tin, Yu nor go gri reward mi. I don taya, na shame and trobol kover mi so. 10:16 If I sey make I karry body up, Yu go porshu mi like lion and na mi Yu go use take show yor pawa. 10:17 Yu must get pipol wey go tok against mi; yor vexnashon dey big evriday by day and na new attack Yu always dey plan for mi. 10:18 “God! Why Yu let my mama born mi? I for don die, before anybody si mi. 10:19 To die for my mama belle, for betta pass dis one wey I dey so. 10:20 Abi my life neva finish? Make Yu leave mi with my own! Abeg, make I enjoy di small life wey I still get. 10:21 I go soon go di land where Yu nor go fit si mi and I nor go kom back again. 10:22 I go-go di dark place where dead pipol and konfushon dey. Place where lite nor dey-dey.”