Job 9
9:1 Den Job ansa:
9:2 “Yes, all dis tins wey yu dey tok so, I don hear dem before. But how pesin go fit take win kase with God?
9:3 Wetin go make pesin argue with God? E go fit ask God kweshon wey E nor go fit ansa?
9:4 God too get sense and en pawa dey mighty; nobody fit stand against am.
9:5 E dey move mountins anytime E wont kon skata dem with vexnashon.
9:6 God wey shake di eart komot from where e dey! E shake di pilas wey support di eart.
9:7 Di One wey kommand di sun and di sun nor raiz; di stars sef nor shine for nite.
9:8 Na only en make di heavens kon waka on-top wave for sea.
9:9 Na God make di Bear, Orion, di Pleiades and di sky for sout.
9:10 Wi nor go fit undastand di great tins wey E dey do and all di wonderful tins wey nobody fit kount.
9:11 Even if God pass naw, I nor go fit si am. If e waka pass, I nor go even smell am sef.
9:12 Nobody fit stop am. E dey take wetin E won take. Nobody fit even ask am, ‘Wetin Yu dey do?’
9:13 If God dey vex, nobody go fit stop am. Even juju for wota dey under en leg.
9:14 “So, na how I won take find word take ansa God?
9:15 Even if I nor do any bad tin, di only tin wey I fit still do na to beg for mesi from God wey bi my judge.
9:16 Even if I koll am and E ansa mi, I nor go bilive sey E dey listin to wetin I dey tok.
9:17 E send breeze kom attack and wound mi, even doh I nor do any bad tin.
9:18 E nor let mi breath well; E don kover my life with bitterness.
9:19 Even if na to use pawa, E strong pass mi. Abi I go fit take am go kourt? Who go fit bring am kom di kourt?
9:20 I know sey I nor do any bad tin, but my mout fit kondemn mi. Even doh I dey innocent, my mout go still fit put mi for wahala.
9:21 I know kare again, life don taya mi, bikos I know sey I nor do any bad tin.
9:22 “All of dem na di same! Na dis make mi dey sey, E dey distroy both who nor do anytin and di ones wey dey do bad tins.
9:23 Wen pesin wey nor do bad tin die like dat, God go just dey laf.
9:24 God don give dis eart to wiked pipol kon kover all di judge dem face. If nor bi en do am, den na who fit?
9:25 “No day good for my life since dem born mi and dem nor dey last.
9:26 My life just dey rush pass like speed boat; like eagle wey won katch rabbit.
9:27 If I tok sey I go forget my komplain or I go try to dey happy,
9:28 my trobols go still kom back again; den I go know sey Yu dey hold mi bikos of di bad tins wey I do.
9:29 If I dey guilty, wetin go make mi komplain?
9:30 Even if I use soap wosh my body and make my hand klean well-well,
9:31 Yu go still trow mi put for dirty pit and even di klot wey I wear, go rijet mi.
9:32 If to sey God na pesin, I for ansa am. Wi for go setol awa matter for kourt.
9:33 Nobody fit setol us! Nobody go fit setol mi and my God.
9:34 Who go fit stop god make E nor ponish mi again, so dat e nor go make mi fear again.
9:35 Den I nor go fear as I dey tok, but naw, nor bi so e bi with mi.