Library · pcm

Job 12

12:1 Den Job ansa: 12:2 “True-true, una know pass evribody. So wen una die, wisdom go follow una die too. 12:3 But I get sense as yu get too. E nor get how yu take betta pass mi, bikos evribody know evritin wey yu dey tok. 12:4 Even my friends dey laf mi naw; dem dey laf, but I know sey I nor do any bad tin. I bilive sey God go ansa my prayers. 12:5 Yu nor get trobol, but yu still dey laf mi; pesin wey won fall before, yu don kuku nak am make e for kwik-kwik fall. 12:6 But tif and pipol wey nor dey fear God dey live for peace, even doh na God hand dem dey. 12:7 “Even bird and animals get many tins wey dem go tish yu. 12:8 Make yu ask di eart and sea make dem kom tish yu wisdom. 12:9 All of dem know sey na God by ensef dey kause all dis wahala for mi, 12:10 bikos na God hand dey hold di eart and evribody dey alive bikos of en pawa. 12:11 But as yor tongue dey taste food, na so too yor ear dey hear word. 12:12 Old pipol get wisdom? Abi long life nor dey bring undastandin? 12:13 But God get wisdom and pawa. E know and undastand many tins. 12:14 Wen God skata, who go fit build am again? And who go fit free pesin wey God put for prison? 12:15 Evriwhere go dry if God sey make rain nor fall and river go only flow wen God gi-am wota. 12:16 Na God get strent and wisdom; di pesin wey dey lie and di one wey dem dey lie give, all of dem dey God hand. 12:17 E dey make leaders bihave like fools kon take wisdom from rulers hand. 12:18 E dey remove kings from dia throne kon make dem prisonas. 12:19 E dey honbol priests and ova-trow doz wey dey pawa. 12:20 E take di wisdom wey old pipol get kon silent doz wey dey advise odas. 12:21 E disgrace princess kon take pawa komot from rulers hand. 12:22 E open all di sekret tins wey dem hide for darkness kon put lite for where deep pass. 12:23 Na-im dey give nashons pawa kon still skata dem again. 12:24 E make leaders bi like fools kon make dem waka lost for desert. 12:25 Dem dey waka find road for darkness. E make dem stagga like man wey don drink well-well.