Job 13
13:1 “True-true, my eyes don si all dis tins, my ear don hear dem and I undastand dem well.
13:2 Wetin yu know, I know am too. Mi and yu na di same.
13:3 But I wish sey I fit tok to God, nor bi yu. I won make mi and God setol dis matter.
13:4 Yu bi oga for lie-lie; yu bi like doctor wey nor fit trit pesin wey dey sick.
13:5 If to sey yu just kwayet, dat for bi wisdom for yu.
13:6 So naw make yu listin to my words; listin as I dey beg.
13:7 Yu won use lie defend God? Abi all dis yor wayo argument na to help God?
13:8 Abi yu dey try to tok for am? Na yu won tok for God?
13:9 If God look yu well-well, E go si any good tin for yor body? Yu feel sey yu fit fool God as yu dey fool human being?
13:10 Even if yu dey pritend sey yu dey sorry for mi, God go still katch and ponish yu.
13:11 Abi en pawa nor go make yu fear? Yu sure sey di fear nor go kill yu so?
13:12 Di words wey yu dey tok nor dey good at-all, dem dey yuzles like ashes; dem dey skata for groun like klay.
13:13 Make yu shut up yor mout, so dat I go tok. Wetin go bi, go bi.
13:14 Why I dey risk my life like dis? Why I dey take decision for mysef?
13:15 Even if E kill mi, I go still dey bilive am; I go still tell am wetin dey do mi!
13:16 E fit bi sey my boldness fit save mi, bikos know wiked pesin go try sey e won face God.
13:17 Naw, make yu listin to wetin I dey try to tok; make yu open yor ear well.
13:18 I don dey ready to komplain gi-am, bikos I know sey I dey rite.
13:19 Anybody fit argue with mi for dis matter? But if Yu sey I dey wrong, I go kwayet till I die.
13:20 Abeg make I ask for two tins and make Yu do dem for mi, den I nor go hide from Yu.
13:21 Make Yu remove yor hand from my life and nor make mi fear again.
13:22 God, make Yu koll mi and I go ansa or make I tok, so dat Yu go ansa mi?
13:23 Wish kind sin I kommit sef? Wish kind bad tin I do? Wish kind wrong tin Yu sey I do?
13:24 Why Yu dey hide from mi? Why Yu dey trit mi like sey I bi yor enemy?
13:25 Na ordinary leaf wey breeze dey blow Yu won fight? Abi na dry leaf Yu won porshu?
13:26 Yu just dey rite bad tins against mi; even di ones wey I kommit wen I bi small pikin.
13:27 Yu don put big shain for my leg and evriwhere wey I waka go, Yu dey wosh mi.
13:28 Naw, I don turn rotin wood and I bi like klot wey worm chop anyhow.