Library · pcm

Job 25

25:1 Bildad kon sey: 25:2 “Na God get pawa pass. E keep en kingdom wey dey heaven for peace. 25:3 Anybody fit kount di angels? Abi e get where God lite nor dey shine rish? 25:4 Anybody fit dey klean before God? How yu wey woman born won take dey pure? 25:5 For God eye, even di moon nor brite and di stars nor shine rish. 25:6 Tok-less of human being wey just bi like worm and magot! Wetin dia life mean to God?”