Library · pcm

Job 26

26:1 Job ansa: 26:2 “Si how yu don help pipol wey nor get pawa. Yu don save pipol wey nor get strent at-all! 26:3 Yu dey give dem good advise kon share wetin yu know with fools, like mi! 26:4 Who yu feel sey go hear all wetin yu dey tok? Na wish spirit make yu dey tok like dis? 26:5 “Dead body dey shake with fear for dia grave. Evritin wey dey inside wota dey shake too. 26:6 Where dead body dey stay just dey open before God; nor-tin fit kover am from en eye. 26:7 God spread di sky for nort kon hang di eart for empty space. 26:8 Na God put wota for di kloud and E nor dey let rain fall from di kloud with force. 26:9 Na-im use di kloud take kover di moon. 26:10 E kreate di sky wen E separate di wota and divide lite from darkness. 26:11 As God tok, di pila wey hold di sky kon dey shake with fear. 26:12 Na en pawa E use take silent di sea. Na en wisdom E take distroy Rahab wey bi di wota juju. 26:13 Wen E breath, di sky dey klear. Na en hand E take distroy di big snake. 26:14 But all dis na small tin kompare to di pawa wey E get. Na small wi don hear. Who go fit really undastand how God strong and great rish?”