Job 27
27:1 Job still sey:
27:2 “As long as God Almighty wey nor gri judge my kase kon make my life bitter dey alive,
27:3 as far I dey breath and God still give mi life,
27:4 my mout nor go ever tok bad and my tongue nor go ever tok lie-lie words.
27:5 I nor go ever agri with wetin una dey tok! I go stand for my rite till I die.
27:6 I nor go ever give up, bikos I dey rite; my mind dey klean and my konscience nor dey judge mi.
27:7 “Make all my enemies, sofa like wiked pipol and doz wey nor know God.
27:8 Doz wey nor know God before dem die, na wish kind hope dem get?
27:9 Wen trobol go kom, God go hear dia kry?
27:10 God go show dem en happiness? Dem go fit koll God anytime wey dem like?
27:11 Make I tish yu how God pawa strong rish. Make I tell yu about di Almighty God plan.
27:12 But I nor go tish yu, bikos yu don si am by yorsef. So wetin make yu dey tok all dis bad tins?”
27:13 Zofar ansa, “Na so God take dey ponish pipol wey dey like trobol and do wiked tins.
27:14 If dia shidren many, dem go die for war and di ones wey remain nor go si food chop beleful.
27:15 Di ones wey manage survive, na sickness go still kill dem and dia wife nor go kry for dem.
27:16 Wiked pipol fit get plenty money like san, dia klot fit plenty pass evribody own,
27:17 but na good pipol go wear dia klot kon kollect dia money.
27:18 Wiked pipol dey build house like spider own or like where hunta dey stay.
27:19 E go sleep as rish man, but wen e wake-up, e nor go si en money again.
27:20 Just as wota dey karry tins go, na so too fear go karry dem go and for nite, breeze go blow dem trowey.
27:21 Strong wind from east go swip dem komot from dia house
27:22 and as dem dey try to run, God nor go sorry for dem and E go blow dem fall.
27:23 Strong breeze go push dem as dem dey run and with en pawa, e go porshu dem komot from where dem dey.”