Job 3
3:1 As last, Job kon tok and e curse di day wey dem born am.
3:2 Job kon sey,
3:3 “Make di day wey my mama born mi disappear and make di nite wey e get my belle, vanish!
3:4 Make di day turn to darkness. God! Make Yu nor remember dat day again; nor let lite shine put again.
3:5 Make darkness and deat shadow kover am! Make betta kloud dey on-top am; make darkness kover en lite.
3:6 Make dat nite komot from kalendar; make dem nor kount am join di days and monts for di year again.
3:7 Make di nite empty and e nor go get joy again.
3:8 Make di pipol wey dey curse day, curse am! Make di pipol wey dey curse wota juju, curse am too.
3:9 Make en morning star remain darkness. Even wen e find lite, make e nor si am and make en day nor break.
3:10 Make Yu curse di day wey my mama born mi, bikos na-im make mi dey face all dis trobol so o-o.
3:11 “Wetin make mi nor die before my mama born mi? Or why I nor die as I just kom out from my mama belle?
3:12 Wetin make my mama karry mi for en lap? Why my mama feed mi with en breast?
3:13 If to sey I die dat time, I for dey rest naw;
3:14 with kings and govnors wey bin build big-big house for demsef for dis eart.
3:15 I for dey rest with prince wey get gold and wey silva full dia palis.
3:16 Why dem nor beri mi like pikin wey die before dem born am? Like pikin wey nor live to si di lite?
3:17 Bikos for grave, wiked pipol nor fit do evil and evribody wey dey der, dey rest.
3:18 Even di pesin wey dey prison before, dey rest, bikos nobody dey opress am for der.
3:19 Evribody dey der, both small and big and even savants dey free from dia oga.
3:20 “Wetin make God dey give lite to pesin wey dey sofa? Why E dey give life to doz wey dey face trobol?
3:21 Dem dey find deat, but dem nor dey si am; dem dey find am pass wetin dey precious.
3:22 Dem dey-dey happy wen dem die go dia grave.
3:23 Wetin God give lite to doz wey nor get tumoro, pipol wey God surround with wahala?
3:24 Instead make I chop, I dey kry and my pain dey pour kom out like wota.
3:25 And naw, evritin wey I dey fear, don dey happen to mi so o-o.
3:26 I nor get peace or rest and my trobol nor gri end.”