Job 4
4:1 Elifaz from Teman kon sey:
4:2 “Job! Abeg, make yu nor vex for wetin I won tok, bikos I nor fit kwayet again.
4:3 Si, yu don tish many pipol and give strent to doz wey dey weak.
4:4 Yor words don support pipol wey won fall and yu don give strent to doz wey don taya.
4:5 Naw wey e rish yor turn to face trobol, yu nor get heart again. Yu nor fit stand am at-all.
4:6 Yu suppose get konfident and hope, bikos yu dey woship and trust God.
4:7 Make yu tink am sef, den tell mi wish time pesin wey dey respet God, dey sick.
4:8 But I don si and know sey, pesin wey plan bad and evil tins, go use en head karry am.
4:9 God dey skata doz kind pipol, bikos E dey vex for dem.
4:10 Wiked pipol dey do like lion, but God go skata and break dia tit.
4:11 Dem go die like lion wey nor si food chop and all dia shidren go skata.
4:12 My savant kom tell mi word small-small, but I nor hear wetin e tok well.
4:13 E kom tell mi like sey na dream for nite wen evribody dey sleep.
4:14 I fear and all my body kon dey shake.
4:15 Na small breeze blow my face kon make my hair stand.
4:16 Sometin stand for der and even wen I look, I nor fit si wetin e bi.
4:17 E get any man wey dey innocent before God? E get anybody wey dey klean before di Pesin wey kreate am?
4:18 If God nor even bilive en savants wey dey heaven; dey si komplain for en angels body,
4:19 yu tink sey E go bilive who E make from san; sometin wey bi dust wey fit skata like ant house?
4:20 Somebody fit dey alive for morning kon die for nite, before odas go know.
4:21 Dem go take evritin wey e get and e die without wisdom.