Job 31
31:1 “I don swear with my eye sey I nor go ever look wimen kon sey I won sleep with dem.
31:2 Wetin God for heaven choose for us? Wetin wi go gain from di Almighty wey dey heaven?
31:3 Shebi trobol na for doz wey dey do bad tins and wahala for wiked pipol?
31:4 God know evritin wey I dey do; E dey si evry step wey I dey take.
31:5 I neva do wiked tin before and I neva ever lie to anybody.
31:6 Make God just test mi weda I dey klean and E go si sey I nor do any bad tin.
31:7 If I don komot from di rite way; if my heart don follow wetin my eye si or if sin full my hand,
31:8 den make anoda pesin chop wetin I plant. Make dem rut and distroy evritin wey I plant.
31:9 If I dey like and won sleep with woman for my heart kon dey wait and hide outside en door,
31:10 den make my wife kook for anoda man chop and make e sleep for anoda man bed.
31:11 Bikos dat go bi big shame and na deat dem take dey ponish dat kind wikedness.
31:12 Make e bi like hell-fire wey dey distroy tins; fire wey go burn evritin wey I get.
31:13 If any of my savant komplain give mi, I dey listin and I dey trit dem well.
31:14 If I nor dey do dem well, how I won take face God? Wetin I won tok if God kom judge mi?
31:15 Na di same God wey kreate mi, kreate my savants too.
31:16 I dey always help poor pipol; I neva let wimen wey nor get husband live for pain
31:17 or allow shidren wey nor get papa and mama dey hongry, while I dey chop.
31:18 Na since wen I small I don dey kare for doz wey nor get papa and mama and till I die, I go always dey kare for wimen wey dia husband don die.
31:19 If I si pesin wey nor get at-all; wey won die, bikos e nor get wetin to wear,
31:20 I go gi-am klot wey dem use my own animal wool take make. Den e go tank mi with en hold heart.
31:21 If I don ever do bad to who nor get papa and mama, bikos I know sey I go win di matter wen wi go kourt,
31:22 den make my hand break. Make e break komot from my shoulder.
31:23 But bikos I dey fear God ponishment, I nor fit do dat kind tin.
31:24 I neva ever bilive money. I nor ever si am as wetin go protet mi
31:25 or kom dey karry body, bikos of di money wey I get.
31:26 I neva ever woship sun, bikos e dey give lite or di moon, bikos e fine.
31:27 I neva for one day like dem rish wen I go kon dey kiss my hand dey woship dem.
31:28 Na deat dem take dey reward dat kind sin; bikos e go mean sey I nor honor God name.
31:29 I neva happy wons, bikos my enemies dey sofa; or dey for peace, bikos dem dey face trobol.
31:30 I neva ever pray make dem die, bikos if I do like dat, God nor go forgive mi.
31:31 My savants neva ever sey, ‘Awa oga let hunga kill some pipol.’
31:32 Doz wey dey travel, I dey koll dem enter my house and I nor dey let dem travel or sleep for road wen nite rish.
31:33 Oda pipol dey try to hide dia sin, but I neva ever hide my own.
31:34 I nor dey kwayet or stay for inside house, bikos I dey fear sey pipol go curse or tok against mi.
31:35 “Nobody won listin to wetin I dey tok? I swear sey evry word wey I dey tok na true. Make God kom ansa mi. Make dem rite wetin my enemies tok about mi, so dat I go si dem.
31:36 I go karry dem without shame for my shoulder kon wear dem like king crown.
31:37 I go dey proud to tell God evritin wey I don do. I go waka go meet am like prince.
31:38 “If I tif di land wey I for dey farm or take am from di original owner,
31:39 or chop di food wey grow for der, so dat di owner nor go si chop,
31:40 den instead of fruit or korn to grow, make bush and grass grow full dat land!” Den Job kon stop to dey tok.