Job 32
32:1 So Job three friends nor gri ansa Job again, bikos dem know sey e dey tok trut.
32:2 Den Elihu wey bi Barakel pikin from Ram family for Buz kon dey vex. E dey vex, bikos Job sey e nor do God anytin.
32:3 E still vex for Job friends, bikos dem nor know how to ansa Job and evritin kon bi like sey, na God dey wrong.
32:4 Bikos na Elihu small pass for der, e wait until evribody tok finish.
32:5 Wen e si sey di three men nor fit ansa Job again, e kon dey vex.
32:6 Elihu wey en papa na Barakel wey kom from Buz kon sey: “I know sey I small and yu don old and na dis make mi dey fear to tell yu wetin I dey tink.
32:7 I tell mysef sey make una tok, bikos una wey don old fit get wisdom wey una go share.
32:8 But I don si am sey na God Almighty spirit dey enter and give human being wisdom.
32:9 Nor bi old age go make pesin wise or tish pipol how to undastand wetin dey rite.
32:10 Naw, I won tok and una go listin to mi. Make I tell una wetin I know.
32:11 I kwayet dey listin to wetin una dey tok since; I dey listin to una wise word and as una dey tink wetin to tok.
32:12 I hear una well-well, but una nor fit show sey Job dey wrong; nobody among una fit ansa en kweshon.
32:13 So why una dey tell pipol sey una get wisdom? Naw, na only God go fit ansa am, bikos una don fail.
32:14 Job dey tok to una; nor bi mi e dey tok to, but if na mi e tok to, I nor go ansa am di way wey una take ansa am.
32:15 “Job, yor words too strong for all of dem; dem nor get ansa for yu.
32:16 Make I dey wait wen dem nor get anytin to tok? Dem just stand for der, bikos dem nor get anytin to tok again.
32:17 But I go give yu my own ansa and I go tell yu wetin I dey tink.
32:18 I nor fit wait to tok or hold my words again.
32:19 If una nor let mi tok, my belle go burst like wine wey dey new wine bag.
32:20 I must tok make I dey free! I nor fit bear-am again!
32:21 I nor go support one pesin for dis matter and I nor go praiz anybody sef!
32:22 I nor sabi praiz pesin anyhow, bikos God go ponish mi, if I do like dat.