Job 37
37:1 “My heart kom dey beat fast-fast as I bigin tink of dis tins.
37:2 Make all of una listin to God vois. Make una listin to di tonda wey dey kom out from en mout.
37:3 Na-im send lite go cross di sky; from one end go rish di oda end for di world.
37:4 Dat time, una go hear di vois well-well kon si di brite tonda lite as e dey pass.
37:5 Wen God tok, e dey bi like tonda and wonderful tins dey happen; tins wey wi nor fit undastand.
37:6 Na-im dey kommand snow and heavy rain sey, make dem dey fall for di eart.
37:7 Na only en fit stop di work wey wi dey do, so dat wi go know how E strong rish.
37:8 Den animals go-go dia house kon stay der.
37:9 Heavy rain dey kom from sout, while strong kold breeze dey kom from nort.
37:10 Wen God breath, wota dey turn to block! Di wota dey block finish!
37:11 E load di kloud with wota and lite dey flash kom out
37:12 as di kloud dey go where God sey make e go. Di kloud dey do evritin wey God kommand for dis world.
37:13 God wey dey send rain kom wota di eart, fit still send am kom ponish or favor us.
37:14 Job, make yu wait small kon listin; konsida all di wonderful tins wey God don do,
37:15 den yu go know how God take dey give kommand and how E take make di lite flash for di kloud.
37:16 Yu know how di kloud take hang for sky? Dat na one tin wey God do wey dey sopraiz evribody.
37:17 Wen yu dey sweet well-well bikos of di heat wey di sout wind dey bring,
37:18 yu fit help God bring di sky kom out kon make am strong like iron wey dem polish?
37:19 Make yu tish us wetin wi go tell God, bikos wi nor get anytin for mind to tok.
37:20 Make dem go tell God sey I won tok to am? Pesin even fit tok wen e konfuse?
37:21 Naw, di lite for sky brite well-well and wi nor fit look am, bikos breeze don swip di eart klean.
37:22 Na golden lite wi dey si for di nort and na glory kover us for God present.
37:23 Wi nor fit kom klose to God, bikos en pawa big well-well! E always dey rite and korrect as E dey deal with us.
37:24 No wonder evribody dey fear am and E nor get anytin to do with pipol wey feel sey dem wise.”