Library · pcm

Job 36

36:1 Elihu still sey: 36:2 “Make yu relax and listin to mi small, bikos I still get some tins to tok for God, as E nor dey here with us. 36:3 I go use wetin I know take show sey God dey rite. I go tok di ones wey I know. 36:4 My words nor bi lie; na betta wise man stand for yor front so. 36:5 True-true, God strong well-well! E nor dey feel sey pesin nor dey yuzful and e nor get anytin wey E nor undastand. 36:6 E nor dey give wiked pipol long life, but E dey judge well for poor pipol. 36:7 E dey protet good pipol; E dey let dem live like kings and pipol dey respet dem forever. 36:8 But if dem shain dem inside prison and dem dey sofa, bikos of wetin dem do, 36:9 God go show dem di rizin. E go show dem dia sin and pride. 36:10 E go make dem listin to en warnin, so dat dem go leave wiked tins. 36:11 If dem hear God word kon serve am, dia life go get peace and dem go prosper. 36:12 But if dem nor gri listin to God word, dem go die and dem nor know anytin before dem go where dead body dey. 36:13 Pipol wey nor know God go just dey vex and even wen E ponish dem, dem nor go sey make E sorry for dem. 36:14 Dem dey die wen dem still yong and na disgrace dey end dia life. 36:15 But God use sofa take dey tish and save en pipol kon korrect dem with pain. 36:16 God remove yu from trobol kon make yu dey save and yu get food full yor tabol. 36:17 But naw, yu dey get di kind ponishment wey fit yu. 36:18 Make yu dey kareful, so dat dem nor go fool yu with money or sey yu follow money go di wrong way. 36:19 E nor go do yu any good sey yu dey kry for help; bikos yu get betta pawa wey nor fit help yu. 36:20 Nor dey wait for nite, wen pipol don go dia house. 36:21 Make yu dey kareful, so dat yu nor go do bad tin, bikos yu dey sofa. 36:22 Make yu remember how God strong rish, bikos na-im dey tish tishas. 36:23 Nobody fit kommand God or akuiz am sey E do bad tin. 36:24 Na praiz pipol dey always praiz am for anytin wey E do. So, yusef must praiz am. 36:25 Evribody don si wetin E do! Na from far wi dey look am. 36:26 “Wi nor fit know how God strong rish. Wi nor fit search or kount how many years God don dey. 36:27 Na God dey take wota from di eart kon turn am to rain. 36:28 E dey let di rain fall from di kloud, so dat pipol go prosper as dem dey work. 36:29 Nobody know how tonda take dey make nois for di sky or how kloud take dey waka for heaven where God dey. 36:30 E dey send lite pass di sky, but under di sea dey-dey dark. 36:31 Dis na how E dey feed and provide plenty food for pipol to chop. 36:32 Na en hand E take dey stop tonda lite kon send am go where E wont. 36:33 Even animals know sey tonda kom before heavy rain dey fall.