Job 39
39:1 Yu know how dem take born di goats wey dey stay mountin? Yu don si wen bush animals dey born before?
39:2 Yu know how long dem dey karry dia shidren for belle? Yu know di time wey dem take dey born?
39:3 Yu know how dem take bend down for groun born dia pikin?
39:4 For inside forest dia pikin dey grow dey strong and wen dem waka go dia own, dem nor dey kom back again.
39:5 Donkey wey dey forest, na who give dem freedom? Who release and let dem dey waka up-and-down?
39:6 Na mi give dem di desert make dem stay. I sey make dem stay di empty land.
39:7 Dem nor dey stay near di town at-all, dem dey far and nobody fit go katch dem kom work.
39:8 Na for mountin dem for dey si food chop, na der dem for dey si green leaf chop.
39:9 How bush melu won take work for yu? E go gri stay one nite for yor yard?
39:10 Yu fit use rope tie bush melu make e for follow yu klear di field?
39:11 Yu sure sey e go gri use en pawa take do yor heavy work?
39:12 Yu dey espect am to bring wetin e harvest kon gada am for di place where korn dey?
39:13 Si as ostrich wey get long leg dey run, but e nor fit fly like stork.
39:14 E dey leave en egg for groun make heat for warm dem.
39:15 E nor dey kare sey pesin leg fit mash di egg or wiked animal fit kom break dem.
39:16 E dey bihave like sey nor bi en get di egg and e nor koncern am if di egg break or skata.
39:17 Na mi make am nor get sense like dat! Na mi nor gi-am wisdom.
39:18 But wen e don start to run, e dey laf horse and di pesin wey dey ride am.
39:19 So Job, na yu make horse strong like dat or na yu give dem hair like klot for dia neck?
39:20 Na yu dey make dem jump like lokust kon make pipol fear wen dem breath?
39:21 Dem dey skata groun as dem dey run for valley; dem dey rush enter war with all dia pawa.
39:22 Dem nor know wetin fear mean and know swod fit make dem turn back.
39:23 Di swod wey who dey ride dem karry, dey make nois and shine for di sun.
39:24 Horse dey run go, bikos dem just dey happy anyhow; even wen dem don blow di trumpet, dem nor go gri stop.
39:25 As dem hear di trumpet dem go vex; dem fit smell war even before dem near der and dem dey hear dia oga kommand.
39:26 Hawk dey kom ask yu make yu tish am wisdom, so dat e go know how to fly wen e spread en feada face sout?
39:27 Abi eagle go wait for yor kommand before e go build en nest for mountin?
39:28 E build en house for di rock wey high pass kon use rock take do pillow for nite.
39:29 From dat place, e dey find sometin wey e go chop, even if e dey near or far.
39:30 Eagle dey gada round dead body, while small eagle dey drink dia blood.”