Job 40
40:1 Den God tell Job:
40:2 “Yu dey argue with God Almighty; yu don taya to tok or yu still get word to tell mi?”
40:3 Den Job ansa God:
40:4 “True-true, I dey tok like fool since, wetin I go fit ansa? I nor go try tok anytin again.
40:5 I don tok pass wetin I suppose tok. I nor get anytin to tok again?”
40:6 Den from inside di storm, God kon ansa Job:
40:7 Make yu stand strait kon ansa my kweshons.
40:8 Yu dey try to sey I dey wiked, bikos yu dey sey I dey wrong and yu dey rite?
40:9 Yu strong rish mi? Abi yor vois loud rish my own?
40:10 If na so, stand up make yu ansa mi; dress like king make yu hail yorsef.
40:11 Look pipol wey tink sey dem dey important, den go honbol dem, bikos yu dey vex.
40:12 Yes! Look dem, make yu bring dem kom down kon skata where wiked pipol stand put.
40:13 Beri all of dem for groun kon tie dem for where dead body dey.
40:14 Den na mi go first praiz yu kon gri sey yu don win di fight by yorsef.
40:15 Si Behemot; I make am di way I make yu, e dey chop grass like melu,
40:16 but si as en strent bi like lion own and e pawa dey en body.
40:17 En tail stand like tall tree and di pawa wey dey e leg, strong well-well.
40:18 En bones strong like bronze and en leg bi like iron bar.
40:19 E dey among di tins wey God kreate wey dey sopraiz pipol! Na only God wey kreate am go fit distroy am.
40:20 Grass wey dem go chop, dey grow for di hill wey bush animals dey for play.
40:21 E dey sleep for under tree wey valley wota dey pass and e go hide among di reeds for di bush.
40:22 Inside bush dey gi-am betta place to rest. Di tall tree dey gi-am shade.
40:23 E nor dey fear wota wey dey rush pass like river; en body go kold wen Jordan River flow pass en face.
40:24 Who fit blind en eyes kom katch am? Na who fit use trap katch am thru en nose and mout?