Library · pcm

Job 41

41:1 “Yu fit use fish hook take katch Leviatan or use rope take tie en tongue? 41:2 Yu fit put rope pass en nose or hook en jaw? 41:3 E go beg yu make yu let am go? Or make e beg yu make yu sorry for am? 41:4 E go gri make agriment with yu kon promise sey e go serve yu forever? 41:5 Yu go fit tie am like bird wey dem dey train for house; or like sometin wey go sweet yor wimen savant to play with? 41:6 Pipol wey dey katch fish go gri follow am enter agriment? Pipol wey dey sell pesin go gri sell am? 41:7 Yu go fit tosh en skin with spear wey dem take dey katch fish or katch en head with hook? 41:8 Make yu try go tosh am, den yu nor go ever try am again; bikos yu nor go ever forget di fight! 41:9 Anybody wey si Leviatan go fear fall for groun. 41:10 Wen dem don make am vex, e go shaut and nobody go try go stand for en front. 41:11 Who don give mi anytin kon sey make I pay back? Evritin wey dey under heaven na my own? 41:12 Make I tell yu about Leviatan leg kon tell yu how e dey big and strong well-well. 41:13 Nobody fit tear en klot wey dey outside or shuk di armour wey e wear. 41:14 Who fit open en mout or bring en tit wey dey make pesin fear, kom out? 41:15 Na many shield dem take make en back kon tie dem togeda and dem strong like stone. 41:16 Dem join dem strong well-well and space nor dey wey breeze fit pass enter en body. 41:17 En body strong well-well and nor-tin fit tear am En body join togeda and nor-tin fit separate dem. 41:18 Wen e sneeze, lite go flash kom out and na so en eye dey shine like sun for aftanoon. 41:19 Fire and tonda lite dey kom out from en mout. 41:20 Like grass wey dey burn under pot, na so too smoke dey kom out from en nose. 41:21 Fire dey kom out from en mout and even wen e breath, e dey bring fire. 41:22 En neck get strong pawa wey fit make evribody wey near am, fear. 41:23 E nor get any weak part for en skin; e dey strong well-well and e bi like iron wey dem nor fit bend. 41:24 En heart bi like stone wey nor dey fear anytin; e dey strong well-well like grindin stone. 41:25 Wen e stand, even pipol wey strong well-well, dey fear and di fear dey make dem shake anyhow. 41:26 No swod fit wound am; no spear or arrow fit enter en body. 41:27 Iron just bi like straw for en eye and bronze dey soft like wood wey don rotin. 41:28 E nor get di arrow wey won make am run, even wen dem stone am with rock, e bi like straw for en body. 41:29 Spear bi like straw to am and e dey laf wen men dey trow arrow kom meet am. 41:30 Di skale wey dey en belle bi like pot wey don break; as e dey waka, e dey leave mark for di mud like sey e won separate di groun. 41:31 E dey shake di sea like wota wey dey boil kon make am dey dance like oil for pot. 41:32 E dey leave shine-shine part for en back kon make di sea get white foam. 41:33 E nor get anytin for eart wey yu fit take kompare am and I kreate am without fear. 41:34 Even di animal wey dey karry body up, e dey look dem like nor-tin; bikos naim bi king among all animals.”