Psalms 102
102:1 My God, make Yu hear my prayer! Make Yu listin to my kry for help!
102:2 Make Yu nor turn from mi wen I dey trobol. Listin and kwik ansa mi wen I koll Yu.
102:3 Bikos my days dey disappear like smoke and my bones dey hot like wetin fire dey burn.
102:4 My heart dey weak; my body dey dry go like grass and I nor fit chop anytin.
102:5 Bikos of di pains wey I dey feel, my bones don almost kom out from my skin.
102:6 I bi like owl for desert; like small owl for inside-inside wildaness.
102:7 I nor fit sleep, I bi like bird wey only en dey on-top roof.
102:8 My enemies dey wahala mi evriday. Dem dey laf and curse mi.
102:9 Na ashes I dey chop as food and my tear dey rush enter my drink,
102:10 bikos of di way Yu dey vex for mi. Yu don pick and trow mi go down.
102:11 My life dey pass kwik-kwik like shadow for evening and I dey die go like grass.
102:12 But Yu, my Oga God go sidan for yor throne forever and evry generashon go know how Yu dey great.
102:13 Yu go raiz-up kon sorry for Jerusalem, bikos dis na di time wen Yu go favor am. Yes! Dis na di rite time to help am.
102:14 Bikos yor pipol love all di stones wey dey di town wall and di dust wey dey di street.
102:15 Just as di nashons go fear wen dem si God, na so too kings go fall wen dem si en glory,
102:16 bikos E go ribuild Jerusalem kon appear inside en glory.
102:17 Pipol wey dey sofa, E go listin to dia prayers. E nor go rijet dem wen dem dey beg am.
102:18 So, make una rite dis tin down for una shidren-shidren, so dat wen dem born dem, dem go praiz God.
102:19 Make una tell dem sey God dey look down from en temple for heaven. E dey look di eart from heaven
102:20 to hear di prisonas kry for help and to release doz wey dem won kill.
102:21 So, make evribody for Zion celebrate God greatness and make dem praiz am for Jerusalem
102:22 wen ever dem and di difren kingdoms gada to woship God.
102:23 E don take my strent, even doh I still dey alive! E don make my days for di world, short.
102:24 I sey, “My Oga God, make Yu nor let mi die naw wen I still dey yong, bikos Yu dey from one generashon go rish anoda.
102:25 Na wen di world just start, Yu build di foundashon for di eart kon make di heavens with yor hand.
102:26 Even wen dem skata, Yu go dey forever. Dem go tear like garment and Yu go remove and distroy dem like one old klot.
102:27 But Yu go always bi who Yu bi; Yu go dey forever.
102:28 Yor savant shidren-shidren go always dey save. Dia shidren-shidren go always dey save for yor present.”