Library · pcm

Psalms 103

103:1 My soul, make Yu praiz God! Make evritin wey dey inside mi, praiz en holy name! 103:2 My soul, make Yu praiz God! Make Yu nor forget all di good tins wey E don do! 103:3 Na-im dey forgive pipol dia sins and dey heal difren-difren diziz. 103:4 E save awa life from di pit kon crown us with mesi and en love wey nor dey fail. 103:5 E satisfy awa life with good tins and even as wi still dey yong, awa life strong like eagle own. 103:6 God dey do wetin dey good and dey judge well for doz wey dem dey opress. 103:7 God show en good works to Moses and en faithfulnes to Israel pipol. 103:8 God dey sorry and show mesi to pipol well-well; E nor dey kwik vex and en love for us nor dey fail. 103:9 E nor dey always akuiz pipol or vex tey for dem. 103:10 E nor dey use as awa sin big rish, take ponish us. 103:11 As di sky high from di eart, na so too en love for pipol wey dey fear and serve am, big rish. 103:12 Just as east far from west, na so too E make awa sins far from us. 103:13 Just as papa dey love and pity for en shidren, na so too, God dey good and dey sorry for doz wey dey fear am. 103:14 Bikos E know how E take kreate us kon remember sey na dust wi bi. 103:15 Awa days for dis world bi like grass; just as flower dey shine kon die, na so too wi dey shine, but small time wi go die. 103:16 Wons heavy breeze blow, di flower dey die komot like sey e nor dey der before. 103:17 But God love go dey forever for pipol wey dey fear am. En salvashon go dey for dia shidren-shidren; 103:18 doz wey dey faithful to en kovenant and dey obey en kommand! 103:19 God don make heaven en throne and na from der E dey rule evritin. 103:20 So angels, make una praiz God: Di strong angels wey dey obey am and listin to all en kommand. 103:21 Yes! Make una praiz God, all di strong angels wey dey serve and do wetin E wont! 103:22 Evritin wey God kreate, make una praiz God for evriwhere for en kingdom. Make my soul praiz God!