Psalms 105
105:1 Make wi tank Oga God! Make wi koll en name kon tell di whole world about di tins wey E don do.
105:2 Make wi sing to am. Yes! Make wi sing to am. Make wi tink about all di wonderful tins wey E do!
105:3 Make wi praiz en holy name and wi wey dey woship God, make wi happy.
105:4 Make wi look for God and en pawa wey E dey give! Make wi always dey look for am!
105:5 Make wi remember all di wonderful tins wey E do; en mirakles and laws wey E give
105:6 us wey bi en savants, Abraham shidren and wi wey bi Jakob wey E choose, shidren-shidren.
105:7 Na-im bi di Oga awa God. Pipol dey si di way E dey judge for di whole land.
105:8 E always dey keep en kovenant; di promise wey E make give 1,000 generashon.
105:9 Dis na di kovenant wey E make with Abraham and E swear about am give Isaak.
105:10 E give di promise to Jakob, just as E kommand and for Israel pipol, na kovenant wey nor dey end, bikos E sey:
105:11 “I go give una Kanaan land and e go bi una special propaty.”
105:12 E tok dis tin wen dem neva plenty and dat time, dem just bi strenjas for Kanaan land.
105:13 Dem waka from kountry to kountry, from one kingdom to anoda.
105:14 Yet, E nor let anybody opress dem. E warn kings bikos of dem sey:
105:15 “Make una nor tosh dis pipol wey I choose and make una nor plan to do bad tins against my profets.”
105:16 E kause honga for Kanaan land wen E nor make di groun bear betta food for dem.
105:17 Den E send Josef go Egypt for en pipol front wen en brodas sell am as slave.
105:18 Di shain for Josef leg kon dey pain am and dem put iron for en neck.
105:19 Until di time rish for Josef to do wetin e dream and tok about, God still dey test en karata.
105:20 Den Fero send for am kon free am. Na di rulers for di nashon open di prison door
105:21 and Fero make Josef oga for evritin wey dey en house; so Josef kon bi oga for evritin wey di king get.
105:22 E fit send doz wey dey serve di king as e wont kon tish doz wey dey advise di king.
105:23 Den Israel kon go Egypt and Jakob stay as strenja for Ham land.
105:24 So God kon make Israel pipol plenty and dem kon too many for dia enemies to handle.
105:25 Den God turn Egypt pipol against Israel pipol and dem kon plan against God pipol.
105:26 But God send en savant Moses with Aaron wey E choose, go free en pipol.
105:27 Dem do wonderful tins for Egypt pipol front and for Ham land.
105:28 God kover Egypt with darkness, bikos dem nor gri allow en pipol go.
105:29 E turn dia wota to blood kon poizin all dia fish.
105:30 Den frog kon full di town and dem even enter di king bedroom.
105:31 Wen God tok, fly kon enter Egypt and worm kon full evriwhere.
105:32 God allow strong block fall for Egypt instead of ordinary rain and tonda dey make nois for di whole land.
105:33 E distroy dia grape vine and fig tree kon skata all dia trees.
105:34 God tok and many-many lokust kon kom; small-small lokust wey dem nor fit kount.
105:35 Dem chop evry green leaf for di land kon kill all di plants for Egypt.
105:36 Den God kill both di pipol and dia animals first-born for Egypt and na dem bi di pride and joy of dia family.
105:37 God take en pipol komot from Egypt with many silva and gold and e nor get any tribe for Israel wey faint for road.
105:38 Egypt pipol happy wen Israel pipol dey komot from dia land, bikos dem dey fear Israel pipol well-well.
105:39 God kover Israel pipol with kloud kon give dem big fire as lite for nite.
105:40 Dem ask for meat and God give dem kwail bird; E give dem manna wey bi bread from heaven, so dat dem go chop beleful.
105:41 E divide di rock and wota kom out kon form river for di dry land,
105:42 bikos E remember en promise wey E make with en savant, Abraham.
105:43 So E take en pipol komot Egypt with joy; di pipol wey E choose with happiness.
105:44 Doz wey nor know am, E give dia land to Israel en pipol and dem plok fruit wey odas plant.
105:45 All dis tins happen make dem for dey follow God laws kon obey en kommand. So make wi praiz di Oga wey bi awa God!