Psalms 104
104:1 My soul, make Yu praiz God! My Oga God, si as Yu dey great! Yor glory dey shine well-well kon kover evriwhere.
104:2 Yor dress dey shine like lite and Yu stresh di sky like curtain for heaven;
104:3 Yu build yor palis kon put am on-top di kloud where rain from dey kom. Yu turn di kloud to yor shariot kon dey ride am on-top di wind.
104:4 Breeze na yor messenja and fire na yor savant.
104:5 Yu build di world on-top strong foundashon, so dat nobody go fit remove am.
104:6 Yu kover di eart with wota and di wota kover di mountins.
104:7 Wen Yu kommand, wota dey vanish and wen Yu shaut, e dey bi like tonda and di wota dey kwik-kwik rush komot.
104:8 Mountins dey raiz-up and valley dey sink go di place wey Yu choose for dem.
104:9 Na Yu set where di sea go flow rish, so dat dem nor go ever kover di eart again.
104:10 Yu turn springs to rivers and dem even dey flow between mountins.
104:11 Dem dey provide wota for all di animals wey dey di field; even wiked donkey sef dey si wota drink.
104:12 Birds dey build house near di rivers and dey sing from tree for bush.
104:13 From God house for heaven, E dey send rain kom wota di mountins, so dat di seed for di eart go grow.
104:14 Yu dey make grass grow for animals to chop kon provide plant for human being to use. Yu allow us produce food from di eart;
104:15 wine wey go make us happy; olive oil wey go make awa skin good and bread wey go give us strent.
104:16 God send rain give en tree make dem for dey grow well; di cedars for Lebanon wey E plant.
104:17 Di birds dey make dia house for der and di stork bird dey stay for di trees wey always dey green.
104:18 Wiked goat dey stay di high mountin; animals for rock dey-dey save inside dia whole.
104:19 God make di moon to mark di mont and di sun dey shine just as God program am.
104:20 God dey bring darkness and nite kom and na dat time, wiked animals for di forest, dey waka.
104:21 Even lions dey kry bikos of honga and dem dey ask God for dia food,
104:22 but wen sun don dey kom out, dem go-go back to dia house go sleep.
104:23 Den men go-go do dia work and dem go work till evening.
104:24 So my God, make Yu si all di difren tins wey Yu don do! Na sense Yu take make all of dem. Na wetin Yu kreate full di whole eart.
104:25 Di sea dey der, both wide and small ones wey get difren tins wey Yu kreate and both small and big fish, dey inside.
104:26 Di ship dey travel on-top sea and Yu still make whale dey swim and play for der too.
104:27 All wetin Yu kreate dey wait for Yu to give dem food wey dem go always dey chop.
104:28 Yu give dem food and dem kollect am; Yu open yor hand to feed dem and dem chop beleful.
104:29 Wen Yu nor ansa dem, dem go dey fear. Wen Yu remove life from dem, dem go die kon turn to san.
104:30 Na yor breath wey dey give life, Yu take kreate dem kon make dem plenty for dis eart.
104:31 God glory go always dey forever! Make God always dey happy for di living tins wey E kreate!
104:32 E look di eart and di eart shake; E tosh di mountin and dem start to bring smoke.
104:33 So I go sing to God as long as I dey; I go sing praiz to my God as long as I dey breath!
104:34 Make wetin I dey tink, make belle sweet am and I go rijoice bikos of my God.
104:35 So, make sinnas vanish komot from di eart and make wiked pipol disappear! Make my soul praiz God! Make wi praiz awa Oga God.