Psalms 107
107:1 Make wi tank God, bikos E dey good! En love wey nor dey fail, dey forever.
107:2 Make pipol wey God don save, tok about am. Make dem tell odas sey E don save dem from dia enemies.
107:3 Bikos E don gada en pipol from many land; from east and west, nort and sout,
107:4 even doz wey dey waka for di wildaness and di ones wey lost and nor get house.
107:5 Dem bin dey hongry and wota nor dey to drink and some even faint as dem dey waka,
107:6 so dem kry as dem dey trobol sey, “Awa God, make Yu kom help us!” So God save dem from dia trobol.
107:7 E take dem go where dem go for dey save; di town where dem go stay.
107:8 So make dem praiz God, bikos of en great love and for di wonderful tins wey E don do for dem.
107:9 Bikos E dey give wota to pipol wey nid am and food to doz wey dey hongry.
107:10 Some sidan for where dark pass and dem shain dem with iron,
107:11 bikos dem go against God word, dem nor gri listin to wetin di Most High God tok
107:12 and na dis rizin make God ponish dem, so dat dem go learn, bikos wen dem fall, nobody dey to help dem.
107:13 Wen dem dey trobol, dem kon kry sey, “Awa Oga God, make Yu kom help us.” So God save dem from dia trobol.
107:14 E komot dem from di darkness kon break di shains.
107:15 So make dem praiz God, bikos of en great love and for di wonderful tins wey E don do for dem,
107:16 bikos E break di prison gate wey dem make with bronze kon kut all di bars wey dem make with iron.
107:17 Bikos some nor get sense, dem kon tok against am and dem sofa for dia sins.
107:18 Dem nor even fit chop and na die remain for dem to die.
107:19 Wen dem dey trobol, dem kon kry sey, “Awa Oga God, make Yu kom help us.” So God save dem from dia trobol.
107:20 E send en words kon heal dem and E take dem komot from deat hand.
107:21 So make dem praiz God, bikos of en great love and for di wonderful tins wey E do for dem.
107:22 Make dem tank am with sakrifice kon sing about di tins wey E do.
107:23 Some use ship for sea dey travel round di world.
107:24 Dem si all di tins wey God dey do; all di wonderful works wey E do for di deep sea.
107:25 E kommand and breeze raiz-up with all di waves for di sea.
107:26 Di waves karry di ship up-and-down for di sea and doz wey dey drive di ship fear well-well, bikos of di great wahala wey di wave dey kause.
107:27 So dem kon dey shake and stagga like pesin wey don drink and all wetin dem know, nor fit help dem.
107:28 Wen dem dey trobol, dem kon kry sey, “Awa Oga God, make Yu kom help us.” So God save dem from dia trobol.
107:29 God stop di wave for di sea and evriwhere kon kwayet.
107:30 Dis kon make doz wey dey drive di ship happy, den di wota karry dia ship go rish land!
107:31 So make dem praiz God, bikos of en great love and di wonderful tins wey E do for dem.
107:32 Make dem praiz am for where pipol dey and for where di leaders for di nashon gada put,
107:33 bikos E turn river to desert and spring wota to land wey dry well-well.
107:34 E turn di land wey get fruit to land wey nor get anytin at-all, bikos of di wiked tins wey di pipol wey dey stay der, dey do.
107:35 But for en pipol, E turn desert to where wota full and dry land to where wota dey flow pass,
107:36 den E bring doz wey dey hongry make dem kon stay and build dia house for der.
107:37 Dem plant seeds and vine for di land kon harvest plenty fruits and food.
107:38 E bless dem, so dat dem go born kon plenty for di land and na so too E make dia animals plenty.
107:39 But as for dia enemies, dem kon dey small more-more, bikos of di pain and sofa wey dem dey face.
107:40 God nor sorry for dia prince, instead E make dem dey waka for di dry and empty land.
107:41 Yet E save poor pipol from doz wey dey opress dem kon make dia family many like plenty animals.
107:42 Wen pipol wey dey obey God si all dis tins, dem go happy, while wiked pipol go shut up dia mout.
107:43 So anybody wey get sense, make e learn from all dis tins and tink about how God good rish and en love wey nor dey fail.