Library · pcm

Psalms 108

108:1 My God, I don make up my mind! I go sing and praiz Yu with all my heart! 108:2 Jita and trumpet, make una wake-up! I go wake-up for early morning kon praiz Yu with song from my mout. 108:3 My God, for evribody present, I go tank Yu. I go sing yor praiz among di nashons. 108:4 Bikos yor love wey nor dey fail, high pass di heavens. Yor faithfulnes dey rish di kloud. 108:5 My God, make all praiz bi yor own and make dem high pass di heavens. Make yor glory kover di whole eart. 108:6 Naw, make Yu save di pipol wey Yu love. Make Yu ansa and save us with yor pawa. 108:7 As God holy rish, E kon promise sey, “I go defeat di pipol kon divide Shekem land with joy, den I go measure Sukkot Valley. 108:8 Na mi get Gilead and Manasseh! Efraim wey I dey wear like helmet for head, go produce strong sojas and Judah wey I dey wear for body like war klot, go produce kings. 108:9 But Moab na my wosh-hand basin; dem bi my savant and I go use Edom take klean my legs kon happy, bikos I don win Filistia pipol.” 108:10 So, who go take mi enter di strong town? Who go fit help mi win Edom pipol? 108:11 My God, Yu don rijet us? Yu nor go follow awa sojas go fight war again? 108:12 Abeg, make Yu help us fight awa enemies, bikos human being help, dey yuzles 108:13 and wi know sey, with God help, wi go do mighty-mighty tins, bikos E go distroy all awa enemies.