Psalms 109
109:1 My God wey I dey praiz, make Yu nor rijet mi
109:2 as wiked pipol dey trobol and lie for my head.
109:3 Dem gada round mi kon dey lie and fight mi without any rizin.
109:4 I love dem, but dem dey try to distroy mi. Even doh I dey pray for dem, yet dem still dey lie for my head!
109:5 Dem dey pay mi bad for good and even doh I love dem, dem hate mi.
109:6 Dem sey, “Make una bring one wiked man wey go tok against am. Make una send pesin wey go tok against am for kourt.
109:7 Wen en kase don rish to judge, make dem sey na-im dey wrong. Make God si en prayers as sin.
109:8 Make en years for life nor plenty and make anoda pesin take en pozishon.
109:9 Make en shidren and wife nor get papa and husband again.
109:10 Make en shidren beg waka and make dem porshu dem komot dia house.
109:11 Make pipol wey e dey owe, kollect all wetin e get and make strenjas take evritin wey e work for.
109:12 Make nobody pity for am; make nobody sorry for en shidren wey nor get papa.
109:13 Make all en shidren die, so dat pipol nor go remember en family name again.
109:14 Make God nor ever forget di sins wey en papa kommit; make God always dey remember en mama sins.
109:15 Yes! Make God always dey remember en sins and make nobody remember en name again.
109:16 Bikos e nor gri help oda pipol; e ponish poor pipol, doz wey nor get and e dey trobol doz wey nor get heart, till dem die.
109:17 E love to curse odas. Naw, make Yu curse am. E nor dey ever bless odas; so naw, make Yu nor bless am.
109:18 To am, to dey curse pesin bi like klot wey dem dey wear for body or wota wey dem dey drink or betta food wey e dey chop.
109:19 Naw, make en curse go back to am kon dey with am like klot for body; make dem tie am round am like belt for en waist.”
109:20 But all di pipol wey dey akuiz and tok bad about mi, make God ponish dem with all dis curse.
109:21 My Oga God wey get pawa, make Yu protet mi, bikos of who Yu bi! Den kon save mi, bikos Yu dey faithful and good.
109:22 I poor well-well! I nor get anytin and na pain full my heart.
109:23 I dey fade komot dis life like shadow; I dey die komot like lokust.
109:24 Bikos I dey fast since, my legs don weak and my body don turn to ordinary skin and bone.
109:25 Pipol for evriwhere dey use mi make yeye; wen dem si mi, dem dey shake dia head dey laf.
109:26 My Oga God, make Yu help mi! Make Yu save mi, bikos of yor love wey nor dey fail.
109:27 Make dem si sey, dis na wetin Yu do kon know sey na Yu my God, do am by yorsef.
109:28 Make dem curse mi if dem like, bikos I know sey Yu go bless mi! Wen dem attack mi, na disgrace go follow dem! But mi, yor savant go always dey happy!
109:29 Make disgrace follow pipol wey dey akuiz mi; make shame kover dem like klot.
109:30 But I go always dey tank God kon praiz am for evribody front,
109:31 bikos E dey protet pipol wey nor get, so dat E go save dem from wiked pipol wey won kondemn dem.