Psalms 111
111:1 Make wi Praiz God! I go tank God with all my heart for di pipol front wey dey obey and gada woship am.
111:2 Si how di tins wey God do dey good well-well and na for pipol wey dey obey am.
111:3 Evritin wey God dey do, dey show en glory and majesty; en raitiousness nor dey ever fail.
111:4 E dey make us remember en wonderful works, bikos awa God dey good and dey show mesi!
111:5 E dey give food to pipol wey dey obey am and E always dey remember en kovenant.
111:6 E don show en pipol en great pawa wen E give dem oda nashons land.
111:7 Evritin wey E dey do dey rite and good and pesin fit trust all en kommand,
111:8 bikos dem bi true word and dem go last forever, so wi must obey dem well and respet dem.
111:9 E diliver en pipol kon make sure sey en kovenant go dey forever. Make una si as en name dey holy and big!
111:10 Na to obey God bi di rite way to get sense and evribody wey dey do wetin E tok, dey get sense and do well. So make praiz bi en own forever and ever.