Library · pcm

Psalms 112

112:1 Make wi praiz God! Pesin wey dey obey and love to do wetin God kommand, blessing dey follow am. 112:2 En shidren-shidren go get pawa for dis world and God go bless di pipol wey dey obey am. 112:3 Dia house get plenty good propaty with money and dia respet na forever. 112:4 Even for darkness, lite dey shine for pipol wey dey fear God. Dem dey good, dey sorry for pipol and dem get respet. 112:5 Pipol wey dey dash oda pipol money, dey do dia business well and na dem good tins dey follow. 112:6 Evil nor go fit kill doz kind pipol. Pipol wey dey raitious and good, pipol dey always remember dem. 112:7 Dem nor dey fear bad news; dem always dey trust God sey E go kare and guide dem. 112:8 Dem get mind and dem nor dey fear as dem dey fight and distroy dia enemies. 112:9 Dem dey share and give wetin dem get to poor pipol for free. Pipol go always remember dia good work forever. Dis kind pipol, go get respet and honor. 112:10 Wen wiked pipol si dis tins, dem go dey fear and worry; dem go grind dia tit dey vex; dem go melt trowey and evritin wey dem wont, go distroy.