Library · pcm

Psalms 113

113:1 Make una praiz God! Una wey bi God savants, make una praiz am! 113:2 Make praiz bi God name naw and forever! 113:3 Pipol go praiz God name from east go rish west. 113:4 Dem dey praiz am ova all di nashons and en glory high pass di sky for heaven. 113:5 Na who wi go take kompare di Oga awa God wey sidan for di high throne? 113:6 E dey bend look di sky and di eart. 113:7 E dey take poor pipol komot from dirty kon remove doz wey nid help from where yeye tins dey, 113:8 so dat E go put dem for where prince dey-dey and dem go dey with en pipol wey bi prince. 113:9 Woman wey nor get pikin, E dey gi-am shidren kon make am dey happy. So, make wi praiz God!