Library · pcm

Psalms 116

116:1 I love God, bikos E dey hear my vois and my prayer for help. 116:2 E dey listin to mi, so as long as I dey alive, I go dey pray to am to help mi, 116:3 bikos deat kover mi like klot and di fear to die go grave, dey make mi shake. Na only sorrow and trobol I dey si. 116:4 So I koll God name: “Oga God, abeg make Yu kom save mi!” 116:5 Naw, make una si as God kind and good rish! Dis awa God too dey pity for pesin! 116:6 God dey protet pipol wey dia faith neva too strong and even wen I dey face deat, E kom save mi! 116:7 So my soul go rest again, bikos God dey good to mi. 116:8 Yes! E save mi from deat kon remove tears from my eyes, so dat I nor go fall. 116:9 I dey waka for God present as I dey for dis world! 116:10 I get faith wen I sey, “My God, I bilive Yu, even doh my mind really dey trobol mi.” 116:11 As I dey vex, I kon sey, “Evribody dey lie well-well!” 116:12 So, wetin I go give God for evritin wey E don do for mi? 116:13 I go dance bikos E diliver mi kon praiz God name forever. 116:14 I go keep my promise wey I make to God for en pipol present. 116:15 God dey kare for en pipol and E dey pain am well-well wen di ones wey E love, dey die. 116:16 My God, I bi yor savant; yes, I bi yor savant wey dem born for yor house and Yu don free mi from di shains kon save mi from deat. 116:17 So I go tank God with sakrifice kon pray to am. 116:18 Na for pipol present I go for do wetin I vow to God 116:19 and na for God house wey dey Jerusalem. So make wi praiz di Oga wey bi awa God!