Library · pcm

Psalms 121

121:1 I go look up to di mountin! Where my help from dey kom? 121:2 My help dey kom from God, di Pesin wey make heaven and eart! 121:3 E nor go let mi kick stone fall; di Pesin wey dey guide mi nor dey sleep. 121:4 True-true, di Pesin wey dey guide Israel nor dey sleep at-all at-all. 121:5 Na God ensef dey wosh ova mi! E stand near mi kon protet mi. 121:6 Di sun nor fit do mi anytin for day time or di moon for nite. 121:7 God dey keep mi from my enemies and E dey protet my life. 121:8 God dey always protet mi both wen I go out and wen I dey kom back! E go protet mi naw and forever.