Psalms 122
122:1 I happy well-well wen dem sey, “Make wi go God house.”
122:2 And na der wi dey naw, as wi stand inside Jerusalem.
122:3 Jerusalem na strong town wey dem build well; so nor-tin go fit skata en wall.
122:4 Israel wey bi God pipol, all en tribes dey go der go woship am. Just as Israel law tok, dem dey kom give God tanks for der.
122:5 Di throne where God for dey judge kase dey for der; di throne wey bi David and en shidren-shidren own.
122:6 So make una pray for peace for Jerusalem and evribody wey love am, go prosper.
122:7 My Jerusalem, make peace follow yu and yor palis go dey prosper forever.
122:8 Bikos of my family and friends, I go sey, “Make peace follow yu.”
122:9 Bikos of awa Oga God house, I go pray make Jerusalem dey prosper.