Library · pcm

Psalms 127

127:1 Unless God build house, di pipol wey dey build am, just dey waste dia time. Unless God guide town, doz wey dey guide am, nor go fit protet am. 127:2 E dey yuzles to work hard from morning go rish nite, bikos of wetin yu go chop. Yes! God dey provide for di pipol wey E love, even wen dem dey sleep. 127:3 Yes! Shidren na God gift; dem bi reward from awa Oga God. 127:4 Pikin wey yong man born, strong like arrow for warrior hand. 127:5 Na dem bi di main rizin wey make man dey happy and shame nor go katch di man even wen e meet en enemies for di town gate.