Library · pcm

Psalms 128

128:1 Make una si di blessing wey dey follow doz wey dey fear and do wetin God kommand. 128:2 Yu go enjoy wetin yu dey work for! Yes! Yu go dey happy and sikure. 128:3 Yor wife go bi like vineyard wey get betta fruit and e go prosper for yor house. Yor shidren go bi like yong olive tree. 128:4 Yes! True-true, dis na God blessing for doz wey dey fear am. 128:5 Make God always dey bless yu from Zion. As long as yu dey alive, yu go si Jerusalem dey prosper. 128:6 Yu go live to enjoy yor shidren-shidren. Make peace always dey Israel land!