Library · pcm

Psalms 129

129:1 Make Israel pipol sey, “Na since wi dey small awa enemies don dey opress us. 129:2 Even doh enemies dey attack us since wi dey small kom rish naw, dem neva ever fit win us. 129:3 Dem don use cutlass kut all awa back like sey na farmer klear am. 129:4 But God dey good; E don kut di rope wey wiked pipol take tie us and naw, wi don dey free. 129:5 So, make evribody wey hate Jerusalem, turn back with shame. 129:6 Make dem dey yuzles like grass wey dey on-top roof, wey go die as e dey grow 129:7 and pipol nor go plok or si am again. 129:8 Yes! Pipol wey dey waka pass nor go sey, ‘Make Oga God bless dem’ or sey, ‘Wi bless una with Oga God name.’ ”