Psalms 143
143:1 My God, make Yu hear my prayers; make Yu listin as I dey pray! Make Yu ansa mi, bikos Yu dey good and evritin wey Yu dey do, dey rite.
143:2 Make Yu nor judge mi yor savant, bikos evribody dey guilty for yor front.
143:3 My enemies don porshu mi. Dem don nak mi fall kon force mi stay for darkness like pipol wey dey grave.
143:4 I nor get hope again and fear don break my body finish.
143:5 I remember before-before as I dey tink about all yor great works and doz tins wey Yu don do.
143:6 I lift my hands and pray to Yu. Just as dry land dey hongry for rain, na so too I dey hongry to si Yu.
143:7 So, my Oga God, make Yu kwik kom ansa mi, bikos my wahala dey worse evriday. Make Yu nor turn from mi, if not, I go die.
143:8 Evry morning, make I dey hear about yor love wey nor dey fail, bikos I trust Yu. Make Yu show mi where to go, bikos I don give mysef to Yu.
143:9 Oga God, make Yu save mi from my enemies; bikos I run kom meet Yu make Yu hide mi.
143:10 Make Yu tish mi to do wetin Yu wont, bikos Yu bi my God and make yor Holy Spirit guide mi as I dey waka.
143:11 My God, make Yu save mi, bikos of di glory wey dey yor name. Save mi from dis wahala, bikos of yor faithfulnes.
143:12 Use yor love wey nor dey fail, take silent all my enemies kon distroy dem, bikos I bi yor savant.