Psalms 144
144:1 I go praiz God wey bi my rock, bikos na-im dey protet mi. Na-im train my hand for war kon give mi pawa to fight.
144:2 E love mi and E dey protet mi. Na inside am I dey hide put and na-im bi di Pesin wey dey diliver mi. Na-im dey kover mi and di Pesin wey dey save mi. Na God dey make pipol obey mi.
144:3 My God, na who wi bi wey Yu dey kare for us like dis? Na ordinary human being Yu dey kare for so?
144:4 Wi just bi like air wey dem dey breath; awa days bi like shadow wey dey fade go.
144:5 Oga God, make Yu open di heavens kon kom down. Make Yu tosh di mountins, so dat smoke go kom out.
144:6 Make Yu shine yor lite kon skata yor enemies! Make Yu shot yor arrow kon konfuse dem!
144:7 Kom down from heaven make Yu save mi; kom save mi from di deep wota and from my enemies pawa.
144:8 Na lie-lie full dia mout; dem swear sey dem go tok di trut, but na lie dem just dey lie.
144:9 My God, I go sing new song to Yu! I go use jita wey get ten rope take sing and praiz Yu.
144:10 Bikos Yu don give yor kings viktory kon save yor savant David from en enemies swod.
144:11 Save and diliver mi from my enemies pawa, bikos na lie-lie full dia mout and even doh dem swear sey dem go tok trut, na lie dem still dey tok.
144:12 Make awa sons prosper for dia yong age like betta plant wey dem put fertaliza. Make awa dotas bi like betta pila wey dem karve for palis.
144:13 Make difren-difren food full awa store house. Make di animals wey dey awa land dey plenty more-more.
144:14 Make awa melu karry many propaty as dem dey kom. Make no enemy break enter awa wall kon katch us and make peace dey awa town.
144:15 Yes! Di pipol wey dis kind tin dey happen to, go happy! True-true, doz wey God bi dia God, go happy well-well.