Library · pcm

Psalms 145

145:1 I go honor Yu wey bi my God and King kon praiz yor name forever and ever. 145:2 I go praiz Yu evriday. Yes! I go praiz Yu forever. 145:3 God dey great! Na only en wi suppose to dey praiz! Nobody fit measure as E big rish. 145:4 Make evribody tell dia shidren-shidren about God mighty pawa; make dem tok about evritin wey Yu don do. 145:5 I go always dey tink of yor majesty, yor wonderful works and all yor mirakles wey yu do. 145:6 I go always dey tok about di wonderful tins wey Yu dey do and I go tell evribody about di great tins wey Yu don do. 145:7 Evribody go tok di story about di wonderful tins wey Yu don do; dem go sing with joy about yor raitiousness. 145:8 God get mesi and dey sorry for pipol! E nor dey kwik vex and en love nor dey ever fail. 145:9 God dey good to evribody. E dey sorry for evritin wey E kreate. 145:10 So Oga God, all yor works go tank Yu and di pipol wey bilive Yu, go praiz Yu. 145:11 Dem go tok about di glory wey dey yor kingdom; dem go tell pipol about yor pawa. 145:12 Dem go tok about di wonderful tins wey Yu don do and about di majesty and glory wey Yu take dey rule, 145:13 bikos yor kingdom go dey forever and ever. Yu dey rule from one generashon go rish anoda. 145:14 God dey help pipol wey don fall kon support doz wey dia load too heavy to karry. 145:15 So my God, evritin dey look up to Yu and Yu dey give dem dia food wen dem wont am. 145:16 Wen Yu open yor hand, doz wey dey hongry and nid wota, Yu dey make dem beleful. 145:17 God dey rite for evritin wey E dey do; na goodness full en body. 145:18 God dey klose to all di pipol wey dey koll am for help; Yes! E dey klose to evribody wey dey koll am with klean mind. 145:19 Pipol wey dey fear am, E dey give dem wetin dem wont; E dey hear wen dem dey kry for help kon save dem. 145:20 God dey protet all di pipol wey love am, but E dey distroy wiked pipol. 145:21 So, I go praiz God and make evribody for eart bless en holy name forever and ever.