Library · pcm

Psalms 147

147:1 Make wi praiz God! Si as e dey good to sing praiz God! Yes, na to praiz God bi di rite tin to do! 147:2 God dey ribuild Jerusalem and E go bring en pipol kom back to Israel from di land where dem dey. 147:3 E heal pipol wey dia heart don break kon trit dia sore. 147:4 E dey kount and koll di stars by dia names. 147:5 Si as awa Oga God big rish! En pawa dey wonderful! Nobody fit undastand how God take dey know tins! 147:6 God dey support pipol wey nor dey karry body up, but E dey kill wiked pipol trowey. 147:7 So, make una sing tank God; make una use harp take sing praiz awa God. 147:8 E kover di heavens with kloud kon make rain fall for di eart, den E make grass grow on-top mountins. 147:9 E dey give food to wild animals kon feed di yong birds wen dem dey kry. 147:10 E nor kare about di pawa wey horse get or di one wey human being get. 147:11 No! But God dey happy for pipol wey dey fear and obey am; doz wey put dia hope for en love wey nor dey fail. 147:12 So, Jerusalem pipol! Make una praiz God! Pipol for Zion, make una gi-am all di praiz! 147:13 Bikos E don make di iron for una gate strong kon bless all una shidren. 147:14 E send peace kom una land kon make una chop betta food. 147:15 E send en laws kom di world; so make una si as en word kwik kom meet una! 147:16 E send snow kom like as wool dey fall; E skata snow for groun like ashes. 147:17 E trow big-big stones with fire kom di eart. So, na who fit stand face God kold breeze wey fit turn pesin to ice-blok? 147:18 But as E kommand, di kold breeze and ice-blok kon melt. E send en breeze and di ice-blok kon turn wota. 147:19 E don show Jakob en word, kommands and rules for Israel pipol. 147:20 E neva do like dis for any oda nashon; no oda nashon know en rules and kommand. So make wi praiz God!