Library · pcm

Psalms 148

148:1 Make wi praiz God! Make wi praiz God from heaven! Make wi praiz am from di sky! 148:2 Make all en angels praiz am! Make all di sojas for heaven, praiz am! 148:3 Make di sun and di moon, praiz am! Make all di stars wey dey shine, praiz am! 148:4 Make di sky, praiz am! Make all di wota wey dey di kloud for up, praiz am! 148:5 Make evritin wey God kreate, praiz am, bikos E just kommand and evritin kon dey as dem dey. 148:6 E put dem for where dem dey forever and ever. Nobody fit tok against en kommand. 148:7 Make all di tins wey dey inside di sea and di ones for land, praiz God. 148:8 Make big-big stones with fire, snow and kloud, wind and weda, obey am. 148:9 Mountins and all di hills; trees and all di cedars; 148:10 wild animals and ordinary animal; animals wey dey creep for groun and birds; 148:11 kings for di eart and all di pipol; doz wey dey rule and judge di eart; 148:12 yong men and yong wimen; old men and shidren, make all of dem praiz God. 148:13 Make all of dem praiz God name. Bikos en name dey great and en glory dey shine for di whole eart and for heaven! 148:14 E don make en pipol strong kon honor pipol wey dey obey am and na dem bi Israel pipol wey dey klose to am. So make wi praiz God!