Psalms 2
2:1 Wetin make pipol wey dey dis world dey vex? Wetin make dem dey make plans wey go fail?
2:2 Di kings for di world gada with rulers kon dey plan against God and di king wey E choose.
2:3 Dem dey sey, “Make wi break di shains wey dem take shain us! Make wi free awasef from dia trap!”
2:4 But di King wey dey heaven dey laf dem anyhow. Yes! God dey laf dem well-well.
2:5 So God kon vex tok to dem and dem bigin fear wen E sey,
2:6 “I don choose my king for Zion wey bi my holy hill.”
2:7 Den di king sey, “I go tell una wetin God kommand. God tell mi sey: ‘Yu bi my pikin! Today, I don bi yor papa!
2:8 Make yu ask mi, and di pipol wey dey dis world, I go give dem to yu as yor propaty and evriwhere for di world, go bi yor own too.
2:9 Na iron rod yu go take break dem kon skata dem like pot wey dem mold with san!’ ”
2:10 So naw, una wey bi king, make una do wetin dey rite; una wey dey rule di world, make una dey take korreshon!
2:11 Make fear dey una heart as una dey serve God! Make una turn from sin kon meet God as una dey fear am!
2:12 Make una dey respet God well-well or E go fit vex kon distroy una at wons, bikos of di way una dey bihave. But na blessing dey follow doz wey si am as dia Oga God!