Library · pcm

Psalms 3

3:1 My God, make Yu si as my enemies many rish! Many of dem dey kom attack mi. 3:2 Many of dem dey sey, “God nor go save am.” 3:3 But Yu, my God, na Yu bi di wall wey dey protet mi; na Yu bi my glory and di pesin wey make mi dey alive. 3:4 Wen I kry to God for help, E ansa mi from en holy hill. 3:5 I dey rest, sleep and wake-up well, bikos God dey protet mi. 3:6 I nor dey fear, even doh doz wey dey attack mi from evry korna, plenty well-well. 3:7 My God, make Yu get up! My God, make Yu save mi! Yes, Yu go slap all my enemies for dia face kon break dia tit! 3:8 Viktory dey kom from God. So, I dey beg Yu, God sey, make Yu bless yor pipol.