Library · pcm

Psalms 23

23:1 Just as shepad dey guide en sheep, na so too God dey guide and provide for mi; so hongry nor go kill mi. 23:2 E dey make mi rest for where good tins dey kon take mi pass river wey kwayet. 23:3 E dey make mi strong. E dey guide and take mi pass di rite road, so dat pipol go honor en name. 23:4 Even doh I waka pass di place wey dark pass and where deat dey, I nor go fear anytin, bikos E dey with mi; en rod and staff dey protet and konfort mi. 23:5 E dey give mi food to chop for my enemies present. E pour oil for my head and my cup kon full dey trowey. 23:6 True-true, en goodness and love wey nor dey fail go dey follow mi till I die and I go dey for God house forever and ever.